DARE ADEBOYE: CONDOLENCE MESSAGES DEY ENTER FOR DI LOSS OF REDEEMED CHURCH PASTOR ENOCH ADEBOYE SON, ‘PASTOR DEE’

Condolence message don dey enter for di popular Nigerian pastor EA Adeboye of Redeemed Christian Church of God (RCCG), afta im son Oluwadamilare Adeboye pass away at di age of 42.

‘Dare Adeboye, wey imsef na minister, bin dey serve as di youth pastor for Akwa Ibom, southern Nigerian for di church wey im papa don lead for decades.

Nigeria president Muhammadu Buhari and former vice president Atiku Abubakar don already send dia condolence give Pastor EA Adeboye, wey im church na di biggest religious organisation for di kontri.

Nigeria current vice president Prof. Yemi Osinbajo, wit some top goment officials go Ogun State, wia di Adeboye family dey live, to say sorry to di family.

Tori about di death of “Pastor Dee” – as dem dey call am – comot early mor mor on Thursday, although confamation don comot about di actual day Dare Adeboye die.

Di official Twitter account of RCCG confam inside post say di yout pastor pass away on 4 May – two days afta di tori comot for media.Skip Twitter post, 1

End of Twitter post, 1

Buhari condole Pastor Adeboye
VP Osinbajo visit Pastor Adeboye
Atiku Abubakar condole Adeboye

About Oluwadamilare Adeboye

  • Dem born am for 9 June 1978, wey go don make am 42 by di time e pass away
  • Im na di third pikin of Pastors EA Adeboye and Folu Adeboye
  • E serve for RCCG church in different roles and different places
  • Im nickname na “Pastor Dee”, or “PD”
  • E dey survived by im wife and three children

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *